Bitcoin matter
wey you fit understand

 

We dey make bitcoin matter simple well well, sotey small pikin fit understand am sharp sharp. Wetin you dey wait for ?

Na for

Everybody

EDUBIN0447
EDUBIN0450
EDUBIN0449
10,000+
Podcast Streams
500+
People Trained
100+
Videos & Memes
20,000+
Social Media Followers

In Circulation

21,000,000

Wetin be Bitcoin ?

Bitcoin na dat ogbonge digital currency wey be the highest for the world. Bitcoin be the first cryptocurrency wey one man wey dem dey call Satoshi Nakamoto release for 2008 ontop internet, Em been dey showcase am everywhere but people no believe say the money go get head.People no begin use am until 2009, Na that year the money begin reach everywhere. Today that same money wey dem dey call Bitcoin don go high well well sotey e don rich $106,000 wey be (N1,559,302,40.00) – Na one point five billion naira  be that O, for just 1 bitcoin. Bitcoin na money wey dey very private, no single person dey control am, no bank or government dey control am, na only market traders dey run am, and na dem dey influence the price wey dey market.

See As market dey Hot

Na the work wey we dey do Be this

Pidgin Bitcoin Podcast
Educational Videos & Memes
Community Events
Translation & Media Collabo

From market gist to money talk, everything dey there for our channel. — Watch am for Our YouTube!

Na there the real gist dey happen.

Who fit Learn Bitcoin ?

Anybody wey wan sabi how money dey change hand fit learn Bitcoin. No be only tech people or big investors dey do am— Bitcoin na for everybody!

Whether you be:

e be like gist for market

“Before, if person talk Bitcoin, e be like big grammar wey I no fit understand. But when I hear am for Bitcoin Pidgin podcast, e be like gist for market. Now I sabi how to save my small profit without wahala.”

Ada

Trader (Onitsha Market)

Dem break am down with story and Pidgin wey make sense

“Na through Bitcoin Pidgin I first learn how Bitcoin really take work. Dem break am down with story and Pidgin wey make sense. I even open my first wallet with confidence. Respect!”

Sola

Student (Lagos)

Dem make am easy for person like me

“Dem make am easy for person like me. I no too sabi English, but I understand everything wey dem dey talk. Now I dey tell my guys for park say make dem no fear Bitcoin again.”

Musa

Okada Rider (Abuja)

-

Shey you go like join our Bitcoin community

Na the people wey dey follow support us for this our work be this.